ads

Sunday, August 31, 2014

Na Oyinbo Save Nigeria Expose Say CBN Dey Sponsor Boko, Ihejirika, Sheriff Dem; Nawaoh

 I don bad for Naija na so. I be tell wena say this issue for Boko Haram na kill man pay. I don happen na say one Oyinbo man don put ye eye see say na so so Naija people dem dey sponsor Boko Haram. You know say some few days back, Uncle Sam ehm people be advise say make dem even catch Lucky Good Luck?
I de wanda whether na only Oyinbo fit save black man; no Nigerian fit do am since all these years. Nawaoh.
God bless Stephen Davis oh! Chai!
Di guy come Nigeria come open fowl behind, spill all the beans wey our President dem, Marilyn Ogar dem dey protect since.
We for never know. If to say na another person tok am, dem for say na APC, thank God say na Jonathan hire dis man oh.
So na CBN dey pay Boko? CBN wey no wan pay Doctor salary, no wan pay University lecturer money.
And dis general Ihejirika, chai, nawaoh! Na revenge for Biafra be dis? Shey da na why dem assassinate general Shuwa wey kill Biafrans for Civil war? me a no no oh. Dis tori long.
Tins dey happen fast, fast for Nigeria dese days, me I jus siddon dey look oh.
I don also hear say mami and papa for Chibok girls dem don buy gun say dem go fight boko haram. Thing dem de happen. 

When News Breaks Out, We Break In. (The 2014 Bloggies Finalist)

No comments: