BBC has reported that as Nigerian President,
Muhamamdu Buhari resumes work after spending over 100 days in London, the
British capital on medical vacation, the president will be working from home. BBC
Pidgin reports that Garba Shehu, Senior Special
Assistant, SSA on Media mata to President Muhammadu Buhari say rodents don
damage di President office and dis na why im dey work from home.
"After
im no dey for office for about three months, rodents don cause plenty damage
for di furniture and air conditioning units wey dey for im office and dis na
why e dey work from home for now,"
Shehu tell BBC.
Shehu
tell BBC say dis na one of di reason why dem dey clean and renovate di office
now.
After
over 100 days in London where im dey on medical vacation, President Buhari
return to Nigeria on Saturday, August 19. Im address di nation on Monday
morning, come send letter to di National Assembly say im don resume work.
But,
on Monday, di President still work from home and people come dey ask wetin
cause this one.
Shehu
say dem just dey clean di office and dis na why di President dey work from di
office wey im get for di residential area of Aso Rock villa, wey bi seat of
government for Nigeria.
Source: BBC Pidgin
When News Breaks Out, We Break In. (The 2014 Bloggies Finalist)
No comments:
Post a Comment